fbpx
December 22, 2024

Why I join Obasanjo to support Peter Obi for 2023 – Adebanjo

0
Ayo-Adebanjo-and-Olusegun-Obasanjo

Di leader of pan-Yoruba socio-political organisation “Afenifere”, Chief Ayo Adebanjo, don come out tok di reason why him and former President Olusegun Obasanjo dey united in supporting di presidential candidate of di Labour Party, Mr. Peter Obi, to win di 2023 presidential election.

Chief Ayo tok say di main koko for di support for Peter Obi na becos say dey wanr one Nigeria.

U FIT ALSO READ 2023: Am di stepping stone to Ndigbos presidency, “seh you dey whine me ni” – Fani-Kayode blast Atiku

According to one interview with tori pipol on Friday, Adebanjo, yarn dis one on behalf of Afenifere, say dey don endorse peter Obi as dia preferred candidate.

One video been surface during di week showing Obasanjo, Adebanjo, Obi and others for one condolence visit to di family of di late Minister of Aviation, Mbazulike Amechi, who kpai at age 93 on November 1, 2022.

Obasanjo for dat gathering no tok anything but hin con later tok say, “ hin believe on anything wey Chief Ayo Adebanjo believes on and hin believe say e no get anything to do with ethnicity, sectional or religious, it is one Nigeria and dat is di goal.

Obasanjo tok say, “ hin believe in equity, justice and one Nigeria. hin tok say hin don shed hin blood for dis countri. at di same time hin don go to prison for dis countri, so wetin persin wan take threaten am for dis countri him never see am at all.

Inside one interview with tori pipol on Sunday, tori pipol ask why Adebanjo dey criticise Obasanjo in di past over some of hin actions when hm bi President,

Hin tok say, “Wetin unite dem na one Nigeria. All those time wey hin dey disagreed with am, base on say hin want better Nigeria for everybodi.

Chief Adebanjo tok say wetin fit help us to amend all di evil things wey President Muhammadu) Buhari government don do for dis countri na to vote better leader wey go turn things around.

Hin tok say after all di Presidential campaigns wey hin don see so far, he dey obvious say di presidential candidates of di All Progressives Congress, Asiwaju Bola Tinubu; and that of di Peoples Democratic Party, Atiku Abubakar, both of dem no get issue but na only Obi been get issues-based on campaign mata.

Hin con tok say for Tinubu followers those one like to dey abuse pipol, while Atiku followers like to dey attack pipol seh na dat kind of pipol dem want make e be Nigeria president?.

Adebanjo con tok say Obi on di other hand na persin wey understand wetin hin wan do for di countri wey go favour everybodi. and for followers mata hin no get any issue at all

To read di full tori CLICKHERE

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *