Wike approve stadium for Tinubu rally for free
Rivers State Governor, Nyesom Wike, don approve di Yakubu Gowon Stadium wey dey Elekahia, Port Harcourt, for di campaign of di presidential candidate of di All Progressives Congress, Bola Tinubu. Di Campaign go hold on February 15, 2023.
Di Rivers State Coordinator of Bola Tinubu Campaign Organisation, Tony Okocha, reveal this update for news briefing for Port Harcourt on Wednesday.
Also, Okocha yarn say all arrangements dey in place to ensure say smooth rally for di APC presidential standard bearer.
Okocha yarn say out of hin kindheartedness, Wike don approve di use of di stadium for Tinubu rally. On top that one, hin no collect di N5m fee from di campaign council.
FOR MOR NEWS: “We don settle fuel and cash scarcity wahala, 2023 elections go hold as planned” – INEC
Wike grant di approval of di alternate venue, di Yakubu Gowon Stadium, Elekahia, Port Harcourt. Di venue na for di presidential campaign rally wey dey scheduled to hold on February 15, 2023 for free of charge.
Okocha, wey follow be di Coordinator of Bola Ahmed Tinubu (BAT-Vanguard for di South-South), yarn say 11-man committee dey ground. Dem go coordinate and ensure di successful hosting of di rally for di state.
In addition, tok say di campaign committee for di state don do dia homework. This na to make sure say Tinubu win for di state.
You fit go read di full tori…READ MORE