fbpx
December 22, 2024

2023: Hunger, stomach infrastructure na di reason why some youths dey support old politicians – Charly Boy

0
Charlyboy-1024x768.jpg

Ahead of di forthcoming presidential election for 2023, veteran Nigerian entertainer and activist, Charles Chukwuemeka Oputa, popularly known as Charly Boy or Area Fada, don come out tok say na hunger and stomach infrastructure bi di reason why some youths dey support old politicians.

Charly Boy, tok say di 2023 election go give chance to actualize ‘Dream of Nigerians’, hin tok say for di countri to survive di pipol must look for new leader wey get human sympathy, integrity, track record, who dey readi to govern di pipol not just to win election only.

U FIT ALSO READ Audiomack don name Asake Artiste of di year for 2022

Inside one interview with tori pipol di entertainer don disclosed hin support for di presidential candidate of Labour Party, LP, Mr. Peter Obi. hin tok say na only Obi fit secure beta future for Nigerian youths.

Charly boy tok say since di journey of him life been an activist na di first time wey him go dey come out to pledge support for any candidate.

Hin tok say di reason why him dey support obi bi say,hin see say majority of di Nigerian youth dey support am. and hin fit do anything to help dem reclaim dia future.

Charly boy tok say no be say we dey look for Messiah or Angel wey go turn everything around in a twinkle of an eye, No,Wetin we want na servant in form of a leader wey dey readi to lead di pipol to di promise land..

Hin don warn Nigerian youth not to miss dis opportunity by next year to vote di right leaders, hin tok say failure to vote wisely, “ hin tok say pipol go prefer make President Muhammadu Buhari still dey for power.”

To read di full tori CLICKHERE

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *