fbpx
May 18, 2024

Police don launch hunt for 22-year-old man wey stab hin mama to death for Kano

22-year-old-man-stab-hin-mama-to-death
Another tori don come out, one 22-year-old suspect stab hin mama to death.
Di Kano State Police Command don launch manhunt for one 22-year-old suspect Ibrahim Musa wey allegedly stab hin biological mama to death.
Dis incident happen around 6:pm on Wednesday, May 3, for Rimin Kebbe Quarters, Nassarawa Local Government Area of di state.
Spokesperson of di command, DSP Abdullahi Kiyawa Haruna, wey confirm di incident inside statement on Thursday, yarn say di deceased, Hajara Muhammad, bin dey brutally stabbed with sharp knife.
Di PPRO yarn say tactical teams dey on ground to make sure say dem arrest di suspect wey escape.
“On 3rd May 2023 at about 1800hrs (6pm), di PPRO receive report.
 One Ibrahim Musa, ‘m’, 22 years old of Rimin Kebbe Quarters, Nassarawa LGA, Kano State stab hin biological mama. Her name na Hajara Mohammed, ‘f’, 50 years old.
Hin stab her with sharp knife for different parts of her body and hin escape from di scene.” Dis na statement from di PPRO.
Immediately as dem receive di report, di Commissioner of Police, Kano State Command, CP Mohammed Usaini Gumel, FIPMA, psc direct di immediate deployment of all police assets to ensure say di perpetrator(s) dey brought to book as soon as practicable,”
Also, dem carry di body with multiple injuries from di scene of pool of blood go Mohammed Abdullahi Wase Specialist Hospital Kano where one Medical Doctor confirm say she don kpai.
Police recover knife with blood stain. Dem suspect say na wetin di suspect use for di attack.
You fit go read di tori of di 22-year-old suspect wey stab hin mama…READ MORE