Only INEC Fit Determine How Results Go Dey Collated Or Transmitted – Court
A Federal High Court for Abuja don rule say only di Independent National Electoral Commission INEC dey empowered by law to determine di mode of collating and transmitting election results.
Justice Emeka Nwite for court follow yarn say only INEC get di power to direct how any polling unit presiding officer go transfer election results, including di total number of accredited voters and results of di ballot.
Also, Justice Nwite still yarn say collating and transferring election results manually for di 2023 general elections no fit dey mentioned as something wey dey contrary to di relevant provisions of di Electoral Act, 2022.
Di judgement bin dey on suit wey dey marked FHC/ABJ/CS/1454/2022 filed by di Labour Party (LP), with INEC as di sole defendant.
FOR MORE NEWS: Yahaya Bello don order arrest of persons and businesses wey dey reject old naira notes for Kogi
LP bin pray say make di court declare say INEC no get power to opt for manual method other than di electronic method wey dey provided for by di relevant provisions di Electoral Act, 2022.
Also, dem suggest to di court say make dem issue order wey go compel INEC to comply with di Electoral Act, 2022 on di electronic transmission of results for di elections.
In addition, inside di judgement wey he deliver on January 23, 2023, Nwite yarn say di plaintiff misunderstand di provisions of di law and after dat one, hin dismiss di suit.
You fit go read di fill tori…READ MORE