fbpx
May 2, 2024

Wahala as Navy officers clash with policemen for police station

navy-officers-clash-with-policemen

A group of Navy officers don storm one police station to beat some policemen wey bin dey on duty.

 

Navy police clash

 

FOR MORE NEWS: “Your place on my list is NUMBER ONE” -Mercy Johnson husband dedicate certificate of return to hin wife inside emotional note

 

Based on reports online,  di matter happen for Enerhen police station wey dey Warri on Friday March 10, 2023.

Di policemen bin allegedly arrest one member of di Navy officers, and na so di newly commissioned naval officer and hin team storm di station to beat dem.

As e be so, di matter don be like water wey pass garri. Everywhere for di community no settle again as dem start to shoot gun. Dis matter make shop owners and residents fly helter sketer for dear life.

Videos don make rounds on top social media as e captures one of di policeman wey dey identified as Kingsley. Dat one don sustain bloody nose as hin dey fight back one of di naval officer.

You fit go read di full gist...READ MORE