fbpx
November 25, 2024

Datti: NBC slam N5m penalty on Channels Television hours after Tinubu petition

nbc-slam-n5m-penalty-on-channels

Di National Broadcasting Commission NBC don slam fine of N5 million on Channels Television . Dis na because dem break di broadcasting law for programme with Dr Datti Baba-Ahmed, Labour Party Vice Presidential candidate.

Also, di matter dey come few hours after di candidate of di All Progressives Congress (APC) for 2023 presidential election, Bola Tinubu petition di station.

Tinubu petition di station over di interview with di LP Vice Presidential candidate.

Inside letter wey dey addressed to di Chief Executive Officer of di television station,  NBC yarn say di station violate di code of conduct.

Di letter, with di title: “Broadcast of an Inciting Interview, A Sanction”, dey signed by Balarabe Ilelah, di commission Director-General.

FOR MORE NEWS: Bank Failures: NDIC dey give Nigerians assurance of safety of bank deposits

Also, part of di statement yarn say di NBC monitor di broadcast of di live interview of di running mate of di Labour Party Vice presidential candidate, Dr Datti Baba-Ahmed.

According to am, di section yarn say no broadcast go encourage, or incite, offensive reference to any person or organisation, alive or dead.

You fit go read di full tori as NBC slam Channels Television…READ MORE