fbpx
May 6, 2024

Air Peace don launch Direct Flight To India

air-peace-launch-direct-flight

West and Central Africa leading airline, Air Peace, don launch direct, nonstop flight services to Mumbai, di capital city of Maharashtra State for Southwestern India.

Di airline go start with two weekly flight frequencies to Mumbai, with plans to start Delhi operations as soon as di Mumbai service garners significant momentum.

Also, as Air Peace launch direct flight, nonstop Mumbai service na break to Nigerians and Indians wey need to travel for so many hours to India with stopovers via other Kontries.

FOR MORE NEWS: I smart pass pipo wey go school – Portable dey boast

Di Chief Operating Officer of Air Peace, Oluwatoyin Olajide yarn say di Mumbai route na dia fourth international destination and e dey strongly indicative of dia commitment to continually expand dia route network to meet di evolving travel needs of not only di Nigerian market but also di West African sub-region.”

She yarn say di airline dey strengthen dia presence for di Asian continent with di launch of Mumbai service.

She add say no be just big stride for di airline; but na huge feat for Nigeria for di  implementation of dia Bilateral Air Services Agreement (BASA) with India, and deepening socio-economic ties between both Kontries.

You fit go read di tori…READ MORE