Bandits don slash ransom for 85 Zamfara abductees
Di bandits wey kidnap 85 pipo for Wanzamai village inside Tsafe Local Government Area of Zamfara State don finally agree to collect N20000 ransom on each of di victims.
Also, dem ask di authorities say make dem withdraw soldiers from di village as part of di conditions for di release of di abductees.
Di time wey dem give na 12 midnight of Sunday as di deadline. Ina addition, dem threaten to kill any victim wey fail to pay di money on or before di time wey dem give.
Also, dem threaten say unless di military personnel wey dey for Wanzamai village don comot for dia, dem go continue to kidnap di villagers.
FOR MORE NEWS: JAMB don announce new date for 2023 UTME
An indigene of the area, Abubakar Na’Allah yarn say di bandits send message say dem go collect only N20,000 from each of di 85 victims as ransom, considering dia financial status.
According to Na,allah , di bandits bin demand di sum of N50m to release di 85 pipo wey dem kidnapped. And most of those pio na women and children wey go forest to fetch firewood last Friday.
But after negotiations, di bandits don agree to collect N20000 from each victim as dem understand say all of dem na from poor families.
You fit go read di tori…READ MORE