fbpx
May 4, 2024

JAMB don announce new date for 2023 UTME

jamb-announce-new-date-for-utme

JAMB don announce new date for di beginning of di 2023 Unified Tertiary Matriculation Examinations UTME.  Di update come from di Joint Admissions and Matriculation Board (JAMB).

Dr Fabian Benjamin, di Head of Public Affairs and Protocol make di announcement inside statement wey dem issue for Abuja on Sunday.

According to di board, di UTME wey bin dey scheduled to start on April 29, go start on April 25, 2023. Additionally, di board don rescheduled dia mock UTME to take place on April 18, 2023.

FOR MORE NEWS: Yul Edochie daughter, Danielle don break silence following di death of her brother, Kambili

Statement on New Date for UTME

In di statement, dem mention say JAMB bin conduct di 2023 Mock-UTME on Thursday, March 30 for  725 centres across di country.

” However, di exercise experience some technical issues for some centres, and di issue there deny some candidates di opportunity to sit for di examination.

According to Dr Fabian Benjamin, candidates wey undergo screening for di examination but bin no fit take am go fit take the mock examination on April 18.

Also, Benjamin confirm say di results of candidates wey participate for di mock examination on March 30 don come out.

You fit go read di tori as JAMB announce UTME new date…READ MORE