NYSC don get new coordinator for Osun
Di Director General of di National Youth Service Corps, NYSC, Brigadier-General Yushau Dogara Ahmed don approve di appointment of Agbor Ndoma Obim as di 15th State Coordinator for di NYSC for Osun State.
Ndoma dey take over di mantle of leadership from Olayinka Abdulwahab, wey dem don transfer to Niger State as Coordinator.
According to statement, before hin appointment, Ndoma na State Coordinator, NYSC Kaduna State.
Also, Ndoma come from Ikom- town, for Ikom Local Government area of Cross Rivers State. Hin attendRokuku Primary School for Ikom-town, and Government Secondary School Ikom (Govisco) for hin secondary school education.
In addition, hin get Bsc in Political Science from di Cross River State University, Uyo, now University of Uyo and Msc for Public Administration from di University of Calabar, Calabar.
FOR MORE NEWS: CCTV capture final moments of Italian-Nigerian Volleyball star, Julia Ituma, wey die after she fall from 6th floor hotel window
Also, hin do one year mandatory service to di nation between 1991- 1992 for Jos North, Plateau State, after hin kon join di services of di Cross River State Post Primary Schools Management Board as Tutor II.
Mr Ndoma join di workforce of di National Youth Service Corps in 1998, as Administrative officer 1. He don serve for different capacities and formations of di Scheme. And hin don work for Lagos, Borno, Enugu and Kaduna State where hin be State Coordinator before hin transfer to Osun State on Wednesday 12th April, 2023.
Di official handing over take place on Friday April 14, 2023, for di NYSC Secretariat for Osogbo.
You fit go read di tori as NYSC approve appointment of Ndoma...READ MORE