fbpx
May 18, 2024

CCTV capture final moments of Italian-Nigerian Volleyball star, Julia Ituma, wey die after she fall from 6th floor hotel window

CCTV-capture-last-moments-of-julia-ituma

A CCTV footage wey capture di last moments of Italian-Nigerian Volleyball star, Julia Ituma, wey die after she fall from a 6th-floor hotel window for Turkey don dey everywhere for internet.

Di terrible incident happen just hours after her team, Igor Gorgonzola Novara, bin dey eliminated from di Champions League semi-finals for Turkey.

Following her team loss, pipo see di 18-year-old Italian volleyball player of Nigerian heritage as she don die on Thursday morning, April 13, outside her hotel for Istanbul, Turkey.

Inside di CCTV footage wey come from di hotel, Ituna bin dey waka slowly for di hallway as she dey press her phone. She kon sit down outside her room door for almost an hour like say something dey her mind.  She dey there before she enter her room for di final time, according to authorities.

 

FOR MORE NEWS: Mercy Johnson pass important message to celebrities wey dey reduce dia age

 

Di volleyball star and ‘next big thing’ wey just dey come out bin represent her team Igor Gorgonzola Novara for dia second-leg knockout match against Turkish side Eczacibasi Dynavit Istanbul, where she bin earn two points despite dia defeat.

As e be be so, nobody don know di circumstances surrounding di tragic accident. However, reports from CCN Turkey yarn say dem see Ituma for ground outside di Valley Hotel around 5.30AM on Thursday morning.

Also, e no too tey wey dem kon announce say  she don die after paramedics and emergency services reach di scene.

You fit go read di tori of Last moments of Julia Ituma…READ MORE