fbpx
November 16, 2024

Woman sell her daughter to settle debt for Ogun State

woman-sell-18-months-old-baby

Ogun State Police Command don arrest one 33-year-old woman, Olaide Adekunle because she sell her 18 months old baby for N600,000 to yet to be identified buyer.

Di suspect, according to statement by di command spokesman, Abimbola Oyeyemi, bin dey arrested following a complain by di woman husband, one Nureni Rasaq wey hin lodge for Sango divisional headquarters.

In addition, Oyeyemi yarn say na Rasaq report hin wife, Olaide Adekunle. Dis na as she comot for house go Lagos on March 15, with dia baby girl, Moridiat Rasaq, but she return without di baby.

FOR MORE NEWS: NAFDAC don approve R21 malaria vaccine

Also, hin tok say all hin efforts to know what wetin happen to di baby no get head. And di woman no gree give any reasonable account of di whereabouts of di baby.

Meanwhile di state acting Commissioner of Police, DCP Babakura Muhammed, don direc say make dem transfer di suspect go di State Criminal Investigation Departments, SCID, for further investigation and possible recovery of di baby.

You fit go read di full tori of di woman wey sell her 18 months old baby…READ MORE