Tinubu no dey under pressure over cabinet – Alake
Di Director of Strategic Communication of di All Progressives Congress Campaign Council, Mr Dele Alake, don deny reports, hin tok say di President-elect, Asiwaju Bola Tinubu, no dey under pressure to choose hin cabinet, with just six weeks to hin inauguration.
Also, hin dismiss rumours wey tok say Tinubu travel abroad for medical attention. Instead, he tok say Tinubu dey follow di developments for di Kontri and hin dey work ahead.
In addition, he yarn say Tinubu dey for relaxed mood, and hin dey work with little or no distraction for Paris andhin no dey in a rush to return home.
“He is relaxing in France and out of the range of pressure. He is taking his time to do his thing. Despite being away for a while, we are always following the news and developments in the country,” Na wetin hin tok be dat.
FOR MORE NEWS: “I no fit locate my husband two years after kidnap” –Wife of Anambra gov candidate
Meanwhile, mixed feelings continue to surround reports say di President-elect fit dey find pipo from opposition parties to put for hin cabinet.
Di tension kon strong well well when a former presidential aspirant on di APC platform, Nicolas Felix, reveal on top Arise TV programme on April 4 say Tinubu go look beyond di party lines to choose hin cabinet and ministers.
Felix na one of di foot soldiers of di president-elect during hin campaign rallies for South-South.
Dele Alake don tok say Tinubu no dey under pressure, You fit go read di tori…READ MORE