fbpx
November 17, 2024

“I dey kampe” – Tinubu dey tell Nigerians

tinubu-comfirm-to-Nigerians-say-hin-dey-kampe

Asiwaju Bola Ahmed Tinubu don come out tok say all di rumors say hin health dey fail na lie. Also, Tinubu comfirm to Nigerians say hin dey kampe, he dey “very strong”.

After Tinubu fly out of di kontri to France for night, rumours full everywhere say dem rush am abroad for medical attention.

Although hin party, di All Progressives Congress, APC, insist say di president-elect only travel to rest and recover from di election stress, some stakeholders don question hin state of health and whereabouts.

 

FOR MORE NEWS: R. Kelly go serve 30-year jail term for North Carolina prison

 

Speaking with some party supporters shortly after hin reach Abuja on Monday, Tinubu yarn say hin don rest well and hin dey refreshed. Also, hin tok with confidence say hin ready for di task ahead.

As hin dey tok to di crowd wey follow am go hin house, na wetin di President-elect tok be dis:

“I’m happy to be back. I have rested, I’m refreshed, and healthy and I’m ready for the task ahead. Forget about what the rumor mill may have told you. I’m strong, very strong.”

You fit go read di tori as Tinubu comfirm say hin dey kampe…READ MORE