“Cubana Chiefpriest abeg come carry me; I be your son” – 19-year-old man dey lament
One young Nigerian man wey claim to share striking resemblance with socialite Cubana chiefpriest don lament online. Hin dey begging Cubana say make hin come for am.
According to di 19-year-old wey identify himself as Emelin, hin dey convinced say hin fit be di pikin of di chiefpriest since pipo dey tell am say hin look like di socialite.
FOR MORE NEWS: “I go bring sexy back” – Media personality, Denrele tok dis one as hin dey receive body massage
He yarn say hin wan go do DNA test since hin mama no wan tell am di truth about di identity of hin father.
Also, hin beg Cubana Chiefpriest say make hin come for am so dat hin no go continue to suffer.
“Why do you leave me to suffer? Come and carry your son. Come and claim me. I’m your son. It’s high time I knew the truth”, Na part of wertin hin tok be dat.
You fit go read di tori about di Nigerian man wey get striking resemblance with Cubana Chiefpriest…READ MORE