fbpx
November 16, 2024

Wike dey under fire for naming new Rivers courthouse after hin wife

wike-dey-under-fire-

Rivers Governor Nyesom Wike dey under fire for naming di new courthouse for di state after hin wife, Suzette Eberechi.

“Every day, people say Wike you are generous. If I’m generous to myself, is it bad? So as I am leaving, let me also name that one (courthouse) after my wife”, Na wetin hin tok be dat.

Di Magistrate Court dey constructed for di Moscow Road wey dey Port Harcourt City Local Government Area (LGA).

Also, di building na one of di projects wey President-elect Bola Tinubu commission during hin visit to di state on Wednesday.

One Twitter user, Aziz Bakare, na hin bring di tok for weekend after he lambasted Wike for acting like say na hin get state funds.

 

FOR MORE NEWS: Police don launch hunt for 22-year-old man wey stab hin mama to death for Kano

 

Inside tweet with hundreds of angry reactions, Bakare yarn say di confidence to make such comment after constructing public facility with tax payers’ money “ dey incredible”.

“To make matter worse, di wife na Judge for di same state.

Di twitter user yarn say make pipo forget di NBA. Hin ask weda di NJC still dey exist?

“Governor Wike no stop there. He also, allegedly, named other buildings for di courthouse after di sitting CJ and other Judges.”

 

You fit go read di tori as Wike dey under fire…READ MORE