fbpx
November 17, 2024

BREAKING: Supreme Court go deliver judgment for Osun guber election dispute May 9

supreme-court-tuesday-judgment

Di Supreme Court on Monday fix Tuesday, May 9, to deliver a make or mar judgment for di July 16 governorship election for Osun State.

And, di apex court fix di 24-hour period for di judgment delivery after hin take arguments from parties wey dey involved in di matter.

Also, di person wey dey di centre of di disputed election na di incumbent Governor Ademola Nurudeen Adeleke.

Hin stand for di poll on di platform of di Peoples Democratic Party, PDP. And, Adegboyega Oyetola na di All Progressives Congress, APC, governorship candidate.

Di Supreme Court go deliver di final judgment by 2 pm on Tuesday.

 

FOR MORE NEWS: Presidential Tribunal: “Make una stop to dey blackmail judiciary” – Onanuga warn PDP, LP, others

 

For di proceedings, wey dem do today, Prince Lateef Fagbemi SAN argue for di APC.

Di Court of Appeal wey dey Abuja on Friday, March 24, bin vacate di tribunal judgment wey nullify di election of Governor Ademola Adeleke of Osun State.

Also, di court for dia lead judgment delivered by Justice Mohammed Lawal, award N500,000 cost against di All Progressive Congress, APC, and its candidate, Gboyega Oyetola.

You fit go read di tori…READ MORE