fbpx
May 17, 2024

Presidential Tribunal: “Make una stop to dey blackmail judiciary” – Onanuga warn PDP, LP, others

onanuga-warn-pdp-and-lp

A spokesperson for Bola Tinubu (President-elect), Mr Bayo Onanuga, don warn di Peoples Democratic Party, PDP, and di Labour Party, LP, say make dem stop to dey blackmail di judiciary.

Onanuga claim say both parties and dia surrogates, wey hin describe as lawyers, clerics and some ethnic groups, don “mount desperate campaign for di postponement of di inauguration of di President-elect on May 29.

He insist say di 2023 election na di best and di most free, fair and transparent since di second republic.

Inside statement issued via hin Twitter handle on Monday, Onanuga tackle di emeritus Catholic Bishop of Abuja, Cardinal John Onaiyekan for hin claim say di election dey rigged. Hin yarn say di claim na nothing but lie and malicious propaganda wey di opposition parties and dia supporters dey tok.

 

FOR MORE NEWS: Peter Obi don tok after hin visit Soyinka amid controversy

 

Hin statement dey come as di presidential election petition tribunal wan begin hearing on Monday.

Also, di spokesman claim say introduction of di Bimodal Voter Accreditation System, BVAS, make a significant difference for di 2023 elections, wey hin describe as di best since di return to democracy in 1999.

Onanuga yarn say pipo wey dey criticize di electoral commission on account of di non-transmission of di results wey dey record for di polling units na just mischievous act.

He insist say na because “di outcome of di election, especially di presidential election no match dia expectation.”

You fit go read di tori as Onanuga warn PDP and LP…READ MORE