fbpx
November 17, 2024

Apapa don give Peter Obi lawyers 48-hour ultimatum over tribunal updates

apapa-give-lawyers-ultimatum

Factional leader of di Labour Party, Lamidi Apapa, don give lawyers of di presidential candidate of di party, Peter Obi, a 48-hour ultimatum to brief am on di ongoing presidential election petitions tribunal.

Dem give di lawyers di ultimatum on Friday, May 12, after Apapa call for a parallel meeting of di National Executive Council of di party for Bauchi state.

Also, dem hold di meeting after a Federal High Court sitting in Abuja rule for hin favour as di acting national chairman of di party.

Justice Hamza Muazu wey yarn say hin go hear di matter, bin adjourn di case till Friday, May 19, for further deliberation.

 

FOR MORE NEWS: Atiku call for revamping of PDP

 

Issuing di ultimatum to Peter Obi lawyers, Apapa yarn say na him dey in charge now and court don confirm hin right to charge until another order takes place.

“Also, hin yarn say as of today, hin be di acting national chairman of di party and any other person wey parades himself as di chairman dey do so illegally.

Finally,hin invite all di lawyers wey dey in charge, representing Labour Party for di election tribunal, say make dem give am updates in di next 48 hours because na him dey in charge and na him dey di driver seat.”

You fit go read di tori as Apapa give lawyers ultimatum…READ MORE