fbpx
November 17, 2024

Election petition: PDP PCC don go spiritual

pdp-declare-prayer-and-fasting-programme

Di Christian Body of di Presidential Campaign Council of di Peoples Democratic Party, PDP don declare a week-long prayer and fasting programme. And di theme na: “At the Supreme Court of Justice of the Universe.”

In addition,  di event go start on May 18th all through to di 25th wey be di day wey dem set for Thanksgiving.

Dis update dey contained on top bold banner wey dey displayed for di main entrance of di party National Secretariat. Na on Tuesday dem display di banner for Wadata Plaze, Wuse Zone 5, Abuja.

According to di announcement, Christian members of di party supporters dey encouraged to join di programme. Also di programme go Centre on #Denouce INEC President-Select#Rescue and Recover PDP for Nigeria.

 

FOR MORE NEWS: Tinubu don meet Kwankwaso for France on peace talk

 

Di event wey go hold for di PDP Chapel dey expected to attract party leaders, members and supporters from all walks of life.

Also, you go remember say di party and di Presidential candidate, Atiku Abubakar don petition di Presidential Elections Petition Tribunal. Dem ask for di nullification of di results of di 2023 Presidential Election. Dis na result wey di Independent National Electoral Commission INEC announce.

Di electoral management body bin announce di candidate of di All Progressives Congress APC, Asiwaju Ahmed Tinubu as winner of di election.

You fit go read di tori as PDP declare prayer and fasting…READ MORE