fbpx
May 17, 2024

Guinea Passport: Group don file fresh suit to stop Tinubu swearing-in

Group-don-file-fresh-suit-to-stop-swearing-in

A civil society organization under di support of di Incorporated Trustees of Advocacy for Societal Rights Advancement and Development Initiative, ASRADI, on Tuesday, approach di Federal High Court for Abuja with fresh suit wey dey seek to stop di scheduled swearing-in of di President-elect, Asiwaju Bola Tinubu, on May 29.

Di group claim say di President-elect lie on oath about hin possession of a Guinean Passport.

Also, dem file affidavit of urgency where dem requested for immediate intervention of di court in view of di planned swearing-in ceremony.

In addition to that, di court apply for order of mandamus to compel di Inspector General of Police, IGP, to investigate and recommend Tinubu for prosecution if hin dey guilty of perjury regarding hin Guinean citizenship.

ASRADI tell di court say di President-elect lie on oath when he no gree give information about hin Guinean citizenship inside di Form EC9 wey hin submit to di Independent National Electoral Commission, INEC, in aide of hin qualification to contest di presidential election wey take place on February 25.

 

FOR MORE NEWS: Election petition: PDP PCC don go spiritual

 

“The non-disclosure by Bola Ahmed Tinubu in the INEC Form EC9 of the dual citizenship of his voluntary acquisition of the citizenship of Guinea amounts to Perjury, ” Na wetin di group add to di affidavit wey dey attached in support of di suit.

The group still add say police fail to act on di request for di matter to dey investigated, and na wetin make dem dey find di intervention of the court.

You fit go read di tori about di Fresh suit to stop swearing-in…READ MORE