Adidas receive backlash after dem release ‘Pride 2023’ women swimsuits wey man model
Social media users dey drag Adidas after di company launch “Pride 2023” swimwear collection, and as dem advertise bathing suits on top dia web site under di “women’s” section with di help of male model.
Adidas no mention weda di model na transgender.
Social media personality, Oli London tweet di screenshots from Adidas’ site on Wednesday morning, May 17 with the caption: “The new Adidas Women’s Swimwear Range modeled by…men.”
FOR MORE NEWS: ‘Murphy Afolabi bin drop hint on hin passing 30 minutes before’- Adekola Tijani
Plenty Twitter users no waste time slam di brand for going “woke.”
Former NCAA swim star and women rights activist Riley Gaines write; “Women’s swimsuits aren’t accessorized with a bulge,”.
Na only women plus-size clothing dem show on model wey appear to be female.
“Maybe Adidas no appreciate large trans models or skinny female models,” one user na hi tok dis one for Twitter.
You fit go read di tori as Social media users drag Adidas …READ MORE