Nancy Isime don react as rapper, Blaqbonez boldly propose to her during live show
Nigerian media personality and actress, Nancy Isime don turn down marriage proposal from popular rapper Blaqbonez.
Di “Back in Uni” star recently make appearance on di latest edition of di Nancy Isime Show and hin use style seize di opportunity to express hin love for di actress, wey don be hin long-time crush during dia conversation.
FOR MORE NEWS: “New Feature” -How to edit messages wey you send for WhatsApp
Also, hin declare hin willingness to marry di beautiful screen diva if she ready to settle down with am.
“Marriage? I will marry. I will marry, but I will be in a different kind of marriage. If you [Nancy] are open to it, I’m in love with you, so”, na wetin hin tok be dat.
However, Nancy quickly reply, “No!”
You fit go read di tori as Nancy Isime turn down Blaqbonez proposal…READ MORE