Tinubu inauguration no go affect tribunal judgement – Atiku lawyer, Uche
Chris Uche, a lawyer to Atiku Abubakar, di presidential candidate of di Peoples Democratic Party, PDP, for di 2023 general election, yarn say di inauguration of President-elect Bola Tinubu no go affect di petitions for di election tribunal.
Tinubu bin dey declared winner on March 1 by di Independent National Electoral Commission, INEC, and dem go swear am in on May 29.
However, Atiku and Peter Obi of di Labour Party (LP) still dey challenge hin victory for court.
Some Nigerians, including di former Catholic Archbishop of Abuja, John Onaiyekan, demand say make dem no swear Tinubu in before di conclusion of di election tribunal.
But speaking with journalists for Abuja on Tuesday, Uche, wey be Atiku lead counsel yarn say di swearing in na only ceremony wey no tie di hands of di court in any way.
Also, di electoral act yarn say di tribunal get 180 days to determine di petitions.
And, dat one mean say di court fit round up di activities on or before September 16, 2023.
You fit go read di tori as di Lawyer tok say di Inauguration no go affect petitions…READ MORE