fbpx
May 18, 2024

Nnamdi Kanu dey in serious pain, hin need urgent ear surgery – Ekpa don raise alarm

nnamdi-kanu-health-condition-don-worse

One popular Biafra person, Separatist Simon Ekpa, don raise di alarm over di worsening health condition of Nnamdi Kanu, di leader of di Indigenous of Biafra.

Ekpa tok inside statement on Wednesday through hin official Twitter handle.

Di Finland-based lawyer and Prime Minister of di Biafra Republic Government in Exile, BRGIE, disclose say Nnamdi Kanu instruct am make hin inform di world say hin ear infection dey worse.

 

FOR MORE NEWS: Tinubu inauguration no go affect tribunal judgement – Atiku lawyer, Uche

 

Hin tok say Kanu urgently need medical surgery for hin ears.

According to am, Nnamdi Kanu no happy as di Nigerian Government no gree obey di court order on hin release.

Ekpa claim say Nigerian judiciary dey no do well as dem continue to delay Nnamdi Kanu trial.

Recall say di Nigerian Government bin re-arrest Kanu in 2019. Despite several court orders, President Muhammadu Buhari and hin pipo no gree grant am bail.

You fit go read di tori on Nnamdi Kanu health condition…READ MORE