fbpx
April 30, 2024

Petrol scarcity: FRSC warn motorists against illegal parking

frsc-warn-motorists

Di Federal Road Safety Corps FRSC, Ogun State Command, don warn motorists for di state against illegal parking for highways and inner roads because dem wan buy fuel.

Mr Ahmed Umar, di Sector Commander of FRSC, give di warning inside interview with di News Agency of Nigeria (NAN) on Friday for Ota, Ogun.

Umar tok against di backdrop of fuel scarcity due to di  removal of subsidy on petrol by di Federal Government.

He yarn say di warning dey necessary to motorists so dat dem no go cause hinder traffic flow across di state.

“Motorists should be orderly and ensure that they do not form more than two lanes in the process of buying fuel,” the sector commander said.

Also, Umar caution motorists against carrying jerry cans inside dia vehicles so dat dem no go endanger dia lives and others, as na dangerous act.

You fit go read di tori as FRSC warn motorists…READ MORE