“Dear mainlanders, how una dey go work for Island everyday?” – Actress, Mary Remmy Njoku dey ask Lagos residents
Nollywood actress, Mary Remmy Njoku, don talk about di struggle of going from Lagos Mainland to Island on a daily basis.
Di ROK TV founder use her Instagram page complain bitterly about di stress after di bad experience wey she pass through.
Mary, wey dey go Island, talk say she comot for her house for mainland as early as 6AM but serious traffic na him hold her for road.
FOR MORE NEWS: My latest movie na farewell, I be next Lagos deputy governor – Funke Akindele
Now she dey ask her fellow mainlanders wey dey work for Island how dem dey do am everyday. She add say the stress to dey comot from mainland go island everyday no dey healthy.
Na wetin di 37-year-old actress write be this:
“Dear fellow mainlanders
How do you go to work on the Island everyday?
I left 6AM and the traffic is mad.
I need the hack pls
You fit go read more of this tori…READ MORE