Burna Boy na my brother, but he dey listen to di wrong people – Shatta Wale
Ghanaian Dancehall star, Shatta Wale don yarn say Afrobeats megastar, Burna Boy na hin brother, but e no dey listen to right advise about some things.
Di Ghanaian singer talk this one as dem interview am for Class ShowBiz about plans to move forward with their friendship after dem end their separation.
For di upcoming Afrochella, dem ask Shatta if he go perform hin song, Hossana wey features Burna Boy, and hin talk say for now everybody go stay on their lane.
FOR MORE NEWS: “Dear mainlanders, how una dey go work for Island everyday?” – Actress, Mary Remmy Njoku dey ask Lagos residents
He yarn say di reason di ‘Common Person’ crooner start to dey beef am na because hin listen to group of people wey comot for hin team and dem kon start to bad mouth am.
Shatta Wale repeat say di African Giant go always be hin brother and hin no fit do anything other than to dey supportive.
He still address di issue with hin new song wey sound similar to Burna Boy’s Last Last. Hin use family analogy about how siblings get similarities and na why their songs sound alike.
You fit go read di full tori…READ MORE