fbpx
November 22, 2024

Keep hope alive, Nigeria go soon change for good – Xmas message from Labour Party youth leader

Labour-Party-Keep-Hope-Alive

Di director of Youth Affairs of di Labour Party Presidential Campaign Council, Isah Abubakar, advise Nigerians make dem keep hope alive even with di security  challenges wey di country dey face.

Abubakar for statement lament about di hardship wey plenty pipo dey experience on a daily basis and hin advise Nigerians make dem no stop to dey pray for way out.

FOR MORE NEWS: Man celebrate hin mama as she graduate from university 20 years after she drop out to take care of am

He add say di celebration of Christmas, di birth of Jesus Christ, na another hope say everything neva lost for di  survival of Nigeria as a great country and so, make we live by di teachings of this season so that we go fit move this country forward in all spheres of life.

As Christians celebrate di birth of Jesus Christ, he advise Nigerians make dem copy di virtues of Jesus Christ we no allow di  lowly place of hin birth stop am from actualizing and maximizing hin potential when hin still dey on earth.

You go like go read di full tori…READ MORE