fbpx
May 18, 2024

Nigerians dey on low key because of fuel crisis and harsh economy

FUEL-SCARCITY-HARSH-ECONOMY-

Christians for Nigeria join dia counterparts across di world today for di 2022 Christmas celebration. Apart from di scarcity of di Premium Motor Spirit, Petrol, wey don make travelling difficult for most Nigerians, to get foodstuffs for di season another major wahala.

Wetin dey clear be say this year celebration no come with plenty fanfare.

FOR MORE NEWS: Na beta police force we go leave behind – Minister

Before, around this period, plenty Nigerians go travel go different parts of di country to celebrate Christmas and di New Year. While some go dia vilage to reunite with dia pipo, others take break from dia regular schedules and work to visit tourist destinations.

But di situation this year don make plenty pipo no fit go on that kain fancy journeys, while those wey don travel dey  and di ones wey still dey plan to travel dey   complain of high fares and fear about dia safety.

Abuja to Benue wey be N4,000 don go up to N8,000 on Saturday. Na one passenger, Mrs Ochanya Theophilus wey no fit pay her transporet fare na hin talk am, she say she no get choice but to go her Abuja house back

You go like read di full tori…READ MORE