fbpx
November 15, 2024

Work-free days for Cross River state: “Go Collect Your Permanent Voters Cards” – Governor Ben Ayade

work-free-days-for-cross-river-state-no-be-pubic-holiday

Work-free days for Cross River State na for di civil and public servants for di state go collect dia Permanent Voters Cards. Governor Ben Ayade, announce di date and e go dey on Thursday, 26 and Friday, 27 January, 2023.

A statement by di Commissioner for Information and Orientation, Eric Anderson, yarn on Friday say di collection of PVCs dey read.  Dem want make pipo fit participate for di 2023 general election wey dey scheduled for Saturday, February 25, 2023 for Presidential and National Assembly elections as well as Saturday, March 11, 2023 for Governorship and State Houses of Assembly Elections.

FOR MORE NEWS: Diphtheria warning alert to Nigerians – NCDC don sound alarm about di disease outbreak

Di Government wan make di general public know say di work-free days for Cross River State no be Public Holidays and make pipo no see am like public holiday.

“Civil and public servantsfor di state dey advised to take advantage of di work-free days to collect dia PVCs in readiness to make dia votes count for di coming elections. Your PVC na di  pathway to achieve excellentelections.”

You fit go read di full tori…READ MORE