fbpx
May 19, 2024

Federal Government Don Deny Increase For Di Pump Price Of Petrol

Federal-Government-Don-Deny-Increase-Of-Pump-Price

Federal Government Don Deny Increase For Di Pump Price Of Petrol

As Federal Government deny increase for di pump price of petrol, oil marketers dey confused.  Even as di cost of di commodity don go high across di country, FG yarn say dem no know about am.

Minister of State for Petroleum Resources, Chief Timipre Sylva, for statement yarn say di President, Major General Muhammadu Buhari (retd.) neva approve any price increase for petrol. Di media aide, Horatius Egua, na hin issue di statement for Abuja on Friday,

Part of di message tok say Mr President dey sensitive to di wahala wey ordinary Nigerian dey face.  Hin don tok am plenty times say he understand di challenges of di ordinary Nigerian and hin no go wan cause  untold trouble for di electorate.”

President Muhammadu Buhari no get reason to withdraw wetin hin don already promise. Hin don tok say he no go approve any increase for di price of PMS at this time.

FOR MORE NEWS: Work-free days for Cross River state: “Go Collect Your Permanent Voters Cards” – Governor Ben Ayade

Di minister add say di government no go approve any increase (in the price) of PMS for secret. Dem no fit increase am without consultation di relevant stakeholders. President Buhari  neva direct di Nigerian Midstream and Downstream Petroleum Regulatory Authority or any agency say make dem increase di price of fuel.

“No be time to increase of di pump price of PMS.”

Hin tok say di increase na di handiwork of some trouble makers and di pipo wey dey plan  to discredit di achievements of di President for di oil and gas sector.

Still on di matter, Sylva yan say make Nigerians calm down and make dem abide by di law, di government dey work hard to bring normalcy to fuel supply and distribution for di country.

This development don make oil marketers confuse, because dem bin don confirm di increase of petrol price by N10. But di minister position don clear di air say FG no get hand for that increase.

 

You fit go read di full tori…READ MORE