Mama give baby ‘Tramadol’ so that she go fit go club – She dey detention now
Mama of pikin give her baby tramadol because she wan go clubbing with friends. Di young lady never dey identified. She bin want make di baby sleep for long and make e no wake up for night.
According to report, di incident happen last night for Likomba, Tiko.
Di mama of one wey bin wan go clubbing get mind feed her months-old baby with tramadol. She bin want make di pikin sleep and make di pikin no wake for night.
FOR MORE NEWS: “Wetin men dey go do for Big Brother Naija House” — PR expert, Big Sam dey ask
Like say that one no do, she lock di baby inside di room. Na so she comot with her friends go club.
However, as di matter be now, Police don arrest her over di death of di child.
Report yarn say di lady commit abomination last night for Likomba, Tiko. Mama get mind give baby tramadol so that she go fit go club.
Na after she return, Forces of law and order don intervene and as of now, di girl dey in detention. Dem don bury di baby now.
You fit go read di full tori…READ MORE