fbpx
May 13, 2024

Adeleke Vs Oyetola: Tribunal don fix date for Judgement

Tribunal don fix date for judgement on Osun election, as the three men panel wey dey touch light matter wey ALL Progressive Congress (APC) and the People democratic Party PDP Summit after the last election for Osun State don finally fixed January 27th, 2023 to deliver Judgment wey go determine who go sit-down for Governorship seat between Ademola Jackson Adeleke and Gboyega Oyetola.

Nah wetin the secretary to the tribunal Mr David Mike, yarn be that in a message he send to the parties wey dia matter dey Court say, tribunal don fix date for Judgeme

Remember say, tribunal collect final address from all wey dey involve for the matter on 13th JANUARY before the tribunal carry dia matter throw for front but as the matter be now tribunal don fix January 27 as the date for final Judgment.

Three-man panel: tribunal fix date

The three-man panel wey Justice Tertse Kume be dia Chairmo, after dem don gather final talk from plaintiff, The first respondent – the Independent National Electoral Commission (INEC), 2nd respondent – Peoples Democratic Party (PDP) and the third respondent – Governor Adeleke assured that, in no distance time, the tribunal go deliver the final Judgement.The Judgment na one wey both All progressive Congress APC believe say dem go win. The People’s democratic party too believe say, the tribunal go reconfirm dia mandate as the Sitting Governor Ademola Adeleke Jackson go carry Oyetola knack for ground for the tribunal.

You go like read: Mama give baby ‘Tramadol’ so that she go fit go club – She dey detention now

Major Issue wey make Oyetola run go tribunal na on top allegation of over voting in the July 16 Governor Election in the 749-polling unit in Osun State but as the matter be now tribunal fix date for judgement. According to State Chairman of APC, Mr Gboyega Famodun, he yarn say he dey sure say by the Grace of God dem believe say APC go reclaim dia mandate.

As the matter be now, everybody dey wait for Friday when the tribunal go drop the judgment.