fbpx
September 29, 2024

“Shey you go like vacation wey Freddie no go dey aware of?” – Man dey flirt with actress Peggy Ovire, she sef don react

Nollywood actress, Peggy Ovire, don give reply her follower wey try to publicly shoot hin shot at her, hin wan dey flirt with her.

It started after Peggy, who’s married to fellow Nollywood star Frederick Leonard, shared stunning new photos of herself on her Instagram page.

Di follower  wey dey fall in love with Peggy Ovire beauty, ignore di fact say she don marry, hin still get mind dey flirt with di married woman.  Na for her Instagram post comment section hin  attempt to flirt with her.

Meanwhile, as Peggy share di photo, for di her caption of di post, she mention her position as Freddie Wife, but that one no stop di fearless follower from openly shooting hin shot.

“Hellurrrr Sweeryyyy!! Let me get your number real quick. How would you like Dubai or Italy for one day? That your brother @freddieleonard won’t know.. 🤓”, na wetin di man write be that.

Di Interesting part be say di comment attract di  actress’ attention and she react to am.

FOR MORE NEWS: “I go use di $50k buy land for my hometown” – Portable don continue hin criticism about TG Omori

For inside her response to di man, she turn down hin offer of a vacation to Dubai or Italy, she kon mention say even her husband fit afford di two of dem.

“@chaz_tv 😂🤣🤣🤣 but he can afford both nah 😂😂”, Na wetin she write be that.

You fit go see di full tori HERE