“Congratulations, I see double blessings from God” – Womb watchers don dey congratulate Mercy Chinwo as she share new photo
Fans and well-wishers of gospel singer, Mercy Chinwo, don flood her with congratulatory messages after womb watchers give di idea say she don get belle with her first child
Di music minister, wey tie di knot with her husband, Pastor Blessed Uzochikwa, for August 2022, don enter her official Instagram page post beautiful photo of herself as she advise women make dem no fall for dia husband tricks this Valentine, and instead make dem demand to be pampered.
She caption di photo, “Someone’s husband is about to tell the wife that everyday is Valentine. My dear sister don’t fall for it oh. My dear sister be wise, I repeat be wise..”
FOR MORE NEWS: “Hin male side dey appreciate hin female side” – Netizens don react to Bobrisky fake N1m alert
Some of di womb watchers no pay attention to Mercy Chinwo message, instead dem focus on di photo. And dem point out say she look pregnant.
On top di matter , dem start to tok say Mercy Chinwo dey expect her first pikin. That one kon make plenty pipo dey congratulate her for di comments section.
Realogo write, “You wan confuse us with your oversize Jacket. But we get double eyes. We don see am. Congratulations nwanyioma.”
Sharon_empire write: “Omo mercy don get belle. I can see it already. Her nose don dey wide.”
NwekeJ write: “Congratulations my dear sister. I see double blessings from God.”
Akuaxaerwe write: “I see twins for Mercy.”
You fit go read di full tori…READ MORE