New naira notes: Election riggers dey push CBN for extension — Atiku
Di Peoples Democratic Party, PDP, presidential candidate, Atiku Abubakar, don call on di Central Bank of Nigeria, CBN, say make dem no postpone di old naira regime deadline after February 10. As e be now, according to wetin Atiku tok, di goal of Election riggers na to push CBN for extension.
This update bin dey disclosed inside statement wey dem issue on Wednesday by Atiku campaign council.
Atiku yarn say election riggers wan push di CBN make dem extend di date till after di 25 February and 11 March general elections so that dem go achieve dia aims.
Also di former vice president ask di apex bank make dem immediately examine di measures wey dem don put in place to ensure di circulation of di new naira notes and ease di difficulty wey Nigerians dey face, especially di pipo wey dey live for rural area.
FOR MORE NEWS: Naira redesign: Kidnapping and banditry don reduce – Emefiele
For inside Part of di statement, dem write say make CBN no agree to further postpone di new naira regime after di expiration of the February 10 deadline.
“In addition, hin yarn say na vote riggers dey find way to di CBN make dem extend am until after di election when dem go achieve dia evil plots.
“In conclusion, he tell CBN and di Presidency make dem stand dia ground for this matter, because di advantage of di new naira policy far outweigh di inconvenience wey pipo dey experience now.”
You fit go see di full tori…READ MORE