fbpx
May 19, 2024

Edo don Confirm 115 Lassa Fever Cases, As Deaths Rise To 13

lassa-fever-deaths-for-edo-don-increase

Di State Commissioner for Health, Prof. Akoria Obehi, don drop update for hin journalists for Benin over di weekend. He yarn say di number of deaths for Edo from Lassa fever don rise to 13. While di cases wey dem don confirm na 113.

According to am, di government don step up dia efforts to contain di disease across communities for di local governments for di state.

As e be now, hin yarn say dem don record eight new cases, with di new figures; dem get 115 persons wey di virus don affect.

FOR MORE NEWS: 11 pipo Burn To Death For Ondo Auto Crash

In addition, hin yarn say those affected pipo dey receive care for di Irrua Specialist Teaching Hospital. Although di Lassa fever deaths for Edo fit dey rise, but dem don prepare to tackle di reported cases.

As hin tok that one finish, hin mention say di state don prepare well.  Dem dey fully equipped to handle reported cases of Lassa fever. Prof. Akoria, charge di people wey experience symptoms like severe headache, vomiting, and high fever, among others say make dem rush go any nearest healthcare for treatment.

 

You fit go read di full tori…READ MORE