fbpx
September 29, 2024

Nigerians go vote inside peaceful atmosphere, says Buhari

nigerians-to=vote-in-peaceful-atmosphere-buhari

Di President, Major General Muhammadu Buhari (retd.), on Thursday, yarn say despite di kind mood wey dey full everywhere during election seasons, hin regime go make sure say Nigerians vote for atmosphere wey dey peaceful for free and fair elections come February 25 and March 11, 2023.

Also, hin tok say hin don make cardinal commitment to make sure say each Nigerian go fit exercise their franchise by participating for free and fair election… In addition, hin tok say na dia objective make sure say e take place for peaceful and conducive atmosphere,” Buhari drop all this update when hin receive di Secretary-General, World Customs Organisation, Dr Kunio Mikuriya, for di State House, Abuja.

FOR MORE NEWS: “No single government go fit solve Nigeria problems” – Buhari don tok

According to statement wey Special Adviser to di President on Media and Publicity sign, Femi Adesina, Mikuriya dey for Nigeria for Global Conference on Fragile Borders with di theme ‘Enabling Customs in Fragile and and Conflict Affected Situations.’

Di title of di statement na ‘How fragile borders fuel terrorism, economic sabotage, and illicit flow of arms, by President Buhari.’

As Buhari dey Commend Mikuriya for hin fourth visit to Nigeria, he yarn say hin latest appearance come when di electorate wan enter polls.

Na that moment Buhari give di assurance say Nigerians go vote inside peaceful atmosphere.

You fit go read di full tori…READ MORE