fbpx
April 26, 2024

Hong Kong wan giveaway free flights after covid isolation

Hong-Kong-giveaway-flights

Hong Kong dey ready to welcome di world again with giveaway, na di leader tok this one on Thursday, as hin launch free flights and positive publicity to resurrect di once-vibrant global hub after three years of Covid-enforced isolation.

Di government rebrand di campaign, “Hello, Hong Kong”, and hin bills hin sef as effort to tell “good stories” about di southern Chinese city, where years of political repression, and  pandemic curbs, don spoil di business-friendly reputation.

Also, dem Promise “no isolation, no quarantine and no restrictions”. During di speech to business and tourism heavyweights, Chief Executive John Lee announce 500,000 free air tickets for visitors so that dem go come experience di city “hustle and bustle”.

Di Hong Kong giveaway of free flights go open for di month of March, with another 80,000 tickets up for grabs to residents for di summer.

FOR MORE NEWS: Usain Bolt don fire hin business manager after $12.7 million miss for inside massive fraud case

“Lee yarn say di thing wey dem wan do fit be di biggest welcome ever for di world.

In addition,  he yarn say  Beijing’s zero-Covid doctrine of quarantine, closed borders and face masks don keep di whole of Hong Kong  virus-free until di deadly Omicron outbreak for di start of 2022.

Although he follow contribute to economic recession and more than 2.5 percent of di population.

Even as business leaders warn Hong Kong say dem go need full Covid exit plan before any meaningful reboot, officials insist say make dem roll di restriction comot gradually.

Hong Kong bin welcomed just 600,000 visitors for 2022, less than one percent of 2018’s figure. More than 130 international companies don close dia Hong Kong offices over di past three years, while recent survey of 253 Japanese companies show say to secure quality workers na dia top concern.

According to official figures, more than 140,000 people comot for Hong Kong labour force last year, when di economy contract by 3.5 percent.

You fit go read di full tori…READ MORE