fbpx
September 29, 2024

Only mentally-challenged people go vote APC – Ayu

ayu-advise-against-vote-for-apc

Di Peoples Democratic Party National Chairman, Iyorchia Ayu, on Monday, advise Nigerians make dem no waste dia vote by voting for APC, di ruling All Progressives Congress.

As hin dey tok on Tuesday during di PDP presidential campaign rally for Benue State, di main opposition party chairman claim say di only people with mental problems na hin go vote for di APC.

Ayu yarn say everybody know say dem don suffer for this country for di last eight years for APC hand, only somebody wey get mental problem go still vote for APC.

Speaking on di PDP internal crisis, Ayu yarn say reconciliation moves dey ongoing and di PDP leadership dey tok with aggrieved party members.

FOR MORE NEWS: PDP Crisis: Wike Don Finally Drops When His Hammer Go Land on Ayu and Other Party Leaders Head

According to am, di party no dey divided, and na only few members get grievances. Hin yarn say dem wan make sure say dem come back to work  fully.

Also, hin appeal to Benue State Governor, Samuel Ortom, say make hin join di PDP campaign train and participate for activities wey go guarantee PDP victory during the presidential election.

“Hin tell  Gov. Ortom say make hin come back and join dem so that dem go  fight to rescue Nigeria.

Ortom and other four aggrieved PDP governors don dey call for di resignation of Ayu after the party presidential primary last year. Dem no like as di Presidential Candidates and National chairman come from di same region.

You fit go read di full tori…READ MORE