fbpx
May 15, 2024

50% PoS operators don close shops over naira scarcity

50%-pos-operators-don-close-shops

Over 50 per cent of Point of Sale operators POS don close dia shops as scarcity of new and old naira notes still continue.

Also, di National Chief Aggregating Officer of di Association of Mobile Money and Bank Agents for Nigeria, Hussein Olanrewaju, don open up about di matter on Monday. Hin yarn say di impact of di ongoing shortage of new and old naira notes don worsen di difficulty of dia members, na why majority POS operators close dia shops.

In addition, hin lament say some Nigerians don take advantage of di situation dey charge unreasonable fees.

He yarn say, “Operators na licensed bodies wey provide platforms wey agents fit leverage on. Currently, agents no get any preferential treatment to deliver this service, hence, more than 50 per cent of agent shops  don close down.

FOR MORE NEWS: CBN Don Give Update on PoS Charges, Dem Go Work With Banks to End Cash Crunch

However, Some agents, go extreme to buy money, and di pipo wey no fit buy dey move from one ATM point to another. Along di line, to get di money dey cost a lot from these agents and na wetin go also reflector di service charge.

Hin tok say e dey worthy to note am say some Nigerians don take advantage of this situation to charge people unreasonable charges.

Hussein further stress say di ongoing policy of swapping cash for unbanked areas fit no dey achieved because of di low number of agents wey dem select for di scheme.

He add say to include agents remain di best solution to ease di financial stress wey Nigerians dey face.

You fit go read di full tori…READ MORE