fbpx
September 29, 2024

“Why I dey alway fight pipo online” – Singer, Portable don open up

why-portable-dey-always--fight-online

Controversial Nigerian singer, Habeeb Okikiola, wey dey popular with di name Portable,don tok why hin no dey ever waste time to fight, drag and call out anybody out online for  social media, especially pipo wey hin feel say dem treat am unjustly.

Di Zazu Zeh star, wey don dey involved for plenty social media dramas since hin rise to fame, open up on di reason why “hin dey always fights online” for recent interview with media personality, Timi Agbaje.

You fit remember say Portable bin don call out Nigerian celebrities like Pocolee, Kogbagidi, Small Doctor, and, most recently, ace cinematographer TG Omori, and others.

Hin accuse dancer and hype man Pocolee say hin attempt to hijack hin hit song “Zazu Zeh”  during di year 2021, and hin bin wan corner money music icon Wizkid, wey spray am money for one event like that.

FOR MORE NEWS: “No be beg una beg me before I shoot Zazu video” – Portable don tackle TG Omori again

E neva to tey wey hin call out hin colleague, Small Doctor, hin accuse that one say e set am up.

However, during di interview with Timi Agbaje, Portable explain say di reason why hin dey involved for social media fights online na so that pipo no go cheat am.

Also, When Timi asked Portable why hin dey fight online, Portable reply hin question with another question. Hin ask Timi Agbaje weda person don rip am before?”

He kon later explain say hin dey always stands up for himself to avoid deceit or manipulation from anybody.

“As them rip you, una no talk, That’s why them dey rip you dey go don’t talk oh.” Na wetin hin add be that.

You fit go read di full tori watch di video…READ MORE