fbpx
September 29, 2024

Naira note scarcity: Beggars dey cry as dem no see money collect from pipo

naira-note-scarcity-follow-affect-beggars

Beggars for Jigawa State dey cry say dem no see money collect because of di Naira note scarcity

Some of di beggars express dia concern as dem dey tok with  DAILY POST for Dutse, di State capital.

Malam Sani, one of di beggars along Kiyawa road for Dutse, yarn say before di Naira note scarcity and policy, hin dey always get enough money for hin needs and hIn family.

According to am, “Before di issue of this new naira note, di money wey hin dey get from pipo dey reach hin transport fare and family needs.

FOR MORE NEWS: Naira Swap: Sterling Bank Don Gift Free Transfers To Customers

“But  now, e dey very difficult to get di money wey hin go use transport himself back to di village,” Na wetin hin tok be that.

Malama Halima, one of di women wey dey beg along Kiyawa road for Dutse, follow lament of how she find am difficult to feed herself and her two children.

Also, she tok say since morning wey she came out, na only N70 she don see and she need to take care of herself and her children.

After di interview with reporter, dem beg di Federal Government say make dem look into di situation and make dem try reduce di suffering of pipo for di country.

As at when this report come out, na only small numbers of beggers dey for street.

You fit go read di full tori…READ MORE