fbpx
May 15, 2024

Naira Swap: Sterling Bank Don Gift Free Transfers To Customers

Sterling Bank Plc don decide to waive all personal account transaction fees as gesture to show say dem dey di same page with dia customers. All dia customer go enjoy free transfers as a way to reduce di difficulty as regards new naira note.

Di CEO of Sterling Bank, Abubakar Suleiman, wey make di announcement via email to customers, yarn say dem recognise di difficult circumstances wey plenty of dia customers dey go through. Also, In light of all di wahala, from February 6, 2023, through February 18, 2023, dia fund transfer services go be free of charge to all personal account customers.

In addition, dem dey glad to inform customers say dem go provide free Debit Cards to all interested customers. E go help provide convenient and secure way to make purchases and carry out transactions.

FOR MORE NEWS: CBN fit fine banks wey dey hoard new notes

Also, di CEO yarn say di free transfers and debit cards na part of Sterling Bank continued efforts to support dia customers and di general public as Nigeria adjusts to di availability of di new naira notes wey don dey go round across di country.

Also, chief marketing officer of Sterling Bank, Dante Martins, add say na di first initiative of on di part of any commercial bank for di country. In addition, hin yarn say dem believe say by eliminating transaction costs for this period, dem fit assist our customers to make dia banking experience easier.

You fit go read di full tori…READ MORE