fbpx
September 29, 2024

Grammy: I no take am for granted, Tems dey appreciate fans for dia support

grammy-tems-appreciate-fans

Singer Temilade Openiyi, wey also dey known as Tems, dey appreciate God and her fans after she achieve her first Grammy Awards.

Days following her victory, Tems enter her Twitter page to express deep appreciation to God almighty.

On Monday, di singer win di Best Melodic Rap Performance category for her contribution for di Future’s ‘Wait For U’ featuring Drake.

Na late on Wednesday she send out di tweet, for inside di post, she write say wetin God do for her, her mouth sef no fit talk am. Also, she give all di glory to God.

Also, after di Grammy award, Tems send message to all her fans wey dey support her through everything to appreciate dem, and she add say she no take am for granted.

FOR MORE NEWS: “Wetin do me after I give old beggar £‎25 for London” – Actress, Angela Okorie don open up

Di award na her first Grammy and her contribution to di hit ‘Wait For U’ by Future featuring Drake na hin make her win di award.

Also, di singer don continue to shine since her rise to stardom, she dey hit remarkable milestones for di music industry both for home and abroad.

You fit go read di full tori…READ MORE