fbpx
September 29, 2024

2023: ‘PDP don bring us shame, make dem no retain power’ – Na Ayu tok this one for Kano campaign

ayu-kano-campaign

Di national chairman of di Peoples Democratic Party, PDP, Iyorchia Ayu, don commit blunder on Thursday during di party presidential campaign wey dem hold for Kano State.

Ayu yarn say PDP don bring shame and di party no suppose retained power.

Although, na di All Progressives Congress, APC na hin e wan mention but slip of tongue go let am mention PDP.

One of di spokespersons for di Tinubu-Shettima Presidential Campaign Council, Festus Keyamo, don rush post di video clip on top hin verified Twitter handle.

According to am, hin yarn say “ for Kano Campaign today, Iyorchia Ayu, di PDP National Chairman, confess say di PDP don bring shame and dem no suppose retain power.

“This obvious costly slip-of-tongue no go make any headlines. Watch out for some press reports on this!,”  Na wetin hin tweet be that.

See video below

https://twitter.com/fkeyamo/status/1623734878658347008?t=rLKVe02uvWrqsbnk3iMUmw&s=19

You fit go read di full tori…READ MORE