fbpx
September 30, 2024

“I go pepper all of una” – Skit maker, Nons Miraj don reply naysayers over new Range Rover Velar

nons-miraj-reply-naysayers

Nigerian skit maker and brand influencer,Chinonso Ukah, wey dey popularly known as Nons Miraj, don reply naysayers wey tok say her new whip come from man. Nons Miraj bin claim say she buy di car for herself for valentine, but pipo dey suggest say na man gift am to her.

Di internet celebrity wey bin recently get matter of allege sugar daddy drama don stir reactions on Friday. This na after she take to her Instagram page on Friday morning, February 10 to show off di luxury whip wey worth millions of naira.

As she dey Flaunt di new whip online, she write, “Valentine came early 💃🏽💃🏽💃🏽 From me to me 🙈🙈”.

However, some “doubting Thomases” wey no believe say na Nons Miraj gift herself di brand new Range Rover Velar via her comments make some remarks.

Well, Nons Miraj don reply her naysayers during her Instagram live session.

FOR MORE NEWS: Actress, Toyin Abraham don react to allege rumour of her death

Nons Miraj mention say na house be next acquisition wey she go get. Also, she ask why people dey make that kain insinuations about her new whip but no go tok anything when other male skit makers flaunts dia expensive cars.

A while ago, Instagram comedian and actress, Nons Miraj open up on di reason why she ditch Nollywood for skit-making.

As she dey tok for interview with Saturday Beats, Nons Miraj yarn say she dey earns more money from skit-making and she get more creative freedom than when she dey act for movies.

According to her, dem dey pay her as low as N30,000 per movie and she go still spend days on set whereas with content creation, she get freedom to do as she pleases and dictate her price.

You fit go read di full tori…READ MORE