fbpx
September 30, 2024

“I no dey chop food wey my wife cook” – Actor, Mr Ibu don open up

mr-ibu-don-reveal-why-hin-reject-hin-wife-food

Veteran Nollywood actor, Mr. Ibu, don reveal say hin no dey chop food wey hin wife, Stella Maris cook again, following dia messy social media drama.

Remember say Stella bin call di actor out last weekend. She accuse say hin dey have affair with hin adopted daughter, Jasmine, and hin abandon dia children.

Although, di couple later reconcile, and Stella deny all her allegations of domestic abuse and infidelity against her husband.

However, speaking on hin marriage crisis fort recent interview with Punch’s Faith Ajayi, Mr. Ibu reveal say Stella dey act loving since last weekend incident, but hin still get hin reservations about her and he no dey eat food wey she cook.

FOR MORE NEWS: Jasmine na my lovely daughter, Mr Ibu wife na hin tok this one after reconciliation with her husband

According to am, “Since di recent incident, she dey loving. But, hin know say all na pretence just to get hin attention. Also, hin tok say he still dey show her love, providing money for domestic needs and making sure say di family dey fine. But, Mr Ibu yarn say he dey very skeptical, and na why hin no fit eat hin wife food again. For now, na only from Jasmine’s kitchen hin dey eat.

Speaking on the current state of hin marriage to Stella, he yarn say,

“This na hin final marriage. If this one fall apart,he no go marry again. This na hin fifth and di worst marriage, because hin wife adopt wetin no dey obtainable.

Mr. Ibu still yarn say hin marriage feel like punishment; not marriage.  Sometimes. hin doubt if hin still dey di marriage, because e be like say Stella don already prepare her mind to leave, and hin no go to stop her.

You fit go read di full tori…READ MORE